Lyrics

He-he-he-he- Graham D nai do the beat Yes! Oko e done hook you RAP Listen! This na the story of my real G Paddy want to make money, Paddy want to buy jeep Paddy dey hustle everyday no holiday Anybody when paddy see him dey ask were the money dey Family too poor, paddy nor finish school Poverty life when you see nor really good Popsi done leggo, mumsy dey sick o And the sister dey one side dey request for school fees o Paddy get to make plans, paddy get to travel na Things when dey happen for family him nor fit handle nah Paddy go to lagos go meet him own paddy, before him own paddy make am to house boy paddy Allah hammer allah inshalla Abeg try to make money – because suffer nor good o Abeg try to make money – because suffer nor sweet o Allah hammer allah inshalla RAP 2 Listen! Back then paddy was fucking broke Him nor dey smile for brokenness nor be funny joke Na who get money dey buy wetin him like chop Even pastor when nor dey see tithe nor go like church You when dey hustle nor worry, you go make am Ogbeni work and pray, one day you go make am Life na step by step, e be like ladder Nor go shook hand for trouble gather piss like bladder Oluwa nor dey sleep, him nor dey slumber Wetin paddy pass through, paddy I nor remember Na one minute call change paddy life, I remember Paddy done dey book flight, Paddy done dey live well Paddy done dey buy house, mumsy done dey live well Paddy done dey buy anything when him want o Paddy done dey cruise in a benz, how e come be? Listen! That's life for you Sometimes e go hard and soft for you Paddy nor forget oluwa when run am for you 100k for him tithe na him run am for you – oshe Allah hammer allah inshalla Abeg try to make money – because suffer nor good o Abeg try to make money – because suffer nor sweet o yeah-eh Allah hammer allah inshalla Yes! Oko e done hook you? Graham D nai do the beat 9jaxclusivemusiq.com True life story.
Lyrics powered by www.musixmatch.com
Get up to 2 months free of Apple Music
instagramSharePathic_arrow_out