Similar Songs
Credits
COMPOSITION & LYRICS
Lionel Tamunokworo
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Large Beatz
Producer
Lyrics
ClassicB one finger in the air mehn
Make you no shame us oh
Make you no shame us oh
Make you no shame us oh
God no go shame us
Make you bless me
Ooh make you bless me
Oh ah oh ahn
Baba God make you bless me
I no want my guys to dey flex me
As dem dey order I wan follow dey order
I no want another man to come dey oppress me
Poverty be like Goliath I be David with the catapult
God give me block so I go fire am
E no go bad If I make this money
So anytime mama ask me I no go waste time to dey wire am
Oluwa dem say we no go make am we don boil water
I know you go bring the garri make we make am
I no be guy man wey get open eye
But e go bad if another man use tinted glass carry my woman pass me
For broad daylight knowing say I no go fit see am
Even if I open eye I stay woke like olosho
For Casablanca this hustle we use buy boxers one day we go use am buy car
Baba God make you bless me
I no want my friends to dey laugh me
Every morning in the night I dey go on my knees Baba God make you bless me
Make you no shame us oh
Make you no shame us oh
Make you no shame us oh
God no go shame us
Eledumare na which day you go answer me
Abi angel Michael no dey show you the missed calls
Dem say money is the root of evil but you dey ask for 10 percent tithe
Does it mean that you are evil Naaaah
Na money naim dey give joy If offering no dey involved some pastors for no dey go church
I wan dey get money
Dey pay my tithe so anytime I ball church So Pastor go dey smile pray for the boy
I no wan be poor man w ey dey frustrate
Dey tell small boys for the street anything for your boy
Bible talk say wetin you believe naim go work for you
Hustle until teacher wey been dey flog you start to work for you
Matthew 7 7knock it shall be opened I don dey knock since
Oluwa abeg break the padlock I know say I be sinner
Bless me for my Mama no want make society use me
As example of bad luck like the woman in the Bible with issue of blood
Until you bless me God me I no fit let go the matter be like you be yahoo boy
And I be SARS If you no bread me how I wan take let go
Baba God make you bless me
I no want my friends to dey laugh me
Every morning in the night I dey go on my knees Baba God make you bless me
Make you no shame us oh
Make you no shame us oh
Make you no shame us oh
God no go shame us
Who sell plantain today fit own plantation tomorrow
Who hawk bread today fit buy the bakery tomorrow
If you give your brother update no mean say you sef no go cash out
They took my umbrella forgetting that my God can stop the rain
No be say we no sabi short cut oh but we no wan ball for 5 years come go 6 feet
This hustle be like marathon and I don tire
Like banny wey dem knack anyhow my legs dey shake Oluwa abeg run am for me
When I think of the kind life I wan live sleep dey comot from my eyes
Naim make I dey hustle
Make my call no come be like noise
I no wan dey shout opor when my guys dey pop champagne
Cos your name dey Tunde you wan dey do giveaway like Tundeednut
But your mama never chop you be Tunde wey head knock
Hard work no be by power na by grace Dangote no fit carry him bag of cement
Stop praying for your enemies to die If you don't want to bury friends
Cos na your cartel go wan knack your girlfriend
Hustle oh cos nobody be your best friend
Family no fit cross street to support your dreams
But dem fit travel miles to come chop your burial rice
But you know wetin go sup? God no go shame us (AT ALL)
Writer(s): Lionel Tamunokworo
Lyrics powered by www.musixmatch.com